Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Becky666
on 30/12/2020, 17:28:48 UTC
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe
<snip>
But no allow the tin put you down. I remember when I small I tell myself if my mama no chop my money nobody go chop am but as I grow older I come dey small pikin talk inside am. The reason we dey alive na to help people, the moment we don help finish we go go visit our marker.
Dat la de simple truth, wen i b small i used 2 talk am sey mama papa na em be my right pensi until i loss him 2 death, but anoda pensi raised me till i grow 2 become a man, we shouldn't choose our favorite between humans but always offer our help to anyone available, by so doing the rewards will always come from the marker.
Quote
Hope say una Xmas dey go well. Merry Xmas and happy new year to all man for here for advancementation. Una tight no be beans. Make una no forget oh our 2021 goal na to get local board anything wey you fit contribute like idea to make an a success bring am come.
We go make am a reality wen de time coms.....