Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
by
CryptopreneurBrainboss
on 26/05/2021, 09:40:47 UTC
So e make sense. If our presido begin use bitcoin logo for him car you no go like am? At least e go bring more investors to buy bitcoin.

Abeg oh make bubu no try am, anything wey e touch dey fail make e no come carry e bad belle enta Bitcoin ecosystem before now we go come dey hear hack up and down. Infact wetin make u reason like dis self, bubu dey confused. Innoson motor e never endorse am by buying for all e cabinet people dem finish na Bitcoin own e come buy abeg make we talk better thing lol.

For the main mata, me I like d plan here but I hope nobi some disguise for other motive as this days I no dey too believe any new development wey outsiders bring come the industry.

That one na based on say everybody wan achieve with the hype wey the industry they get and no care at tall about our progress as a community and industry wey dey try make people understand wetin financial freedom for dey all about.