So e make sense. If our presido begin use bitcoin logo for him car you no go like am? At least e go bring more investors to buy bitcoin.
Abeg oh make bubu no try am, anything wey e touch dey fail make e no come carry e bad belle enta Bitcoin ecosystem before now we go come dey hear hack up and down. Infact wetin make u reason like dis self, bubu dey confused.
Lol I been just dey give instance from one of our own but for sure if baba endorse bitcoin Nigeria go be the talk of the town, you know say na we be number one for Africa wey sabi crypto.
This is my one first post for this forum. I wan use this opportunity to hail my Naija broda's and sisters for this forum before I continue to sail my ship for this forum. I hope am welcomed.
Abeg brother we welcome ooo you go try join the telegram group make other brothers see you too and try dey active dey write better thing wey we go gain knowledge from so we fit grow together for her...
Abeg na which ship you dey sail for dry land
