As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app

. Our country na yeye.
You dey mind Linus Mohammed? The surprising thing be sey most of these yeye people wey dey yarn dust be highly educated people oh. But their belle because of wetin dem wan eat nor dey allow dem brains work well. Shebi Linus na lawyer sef. Dem forget sey even Jack delete Donald Trump tweet and nothing happen. Jack wey dey US still get mind delete Trump message and nothing happen to am, no FBI worry am. If na naija the guy dey those fish brains for don worry am tey tey.
Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.
Since wey that nonsense man wey call himself Mohammed announce the ban of Twitter for we country naija, my Twitter dey work well even until yesterday night, na this morning I come discover say the app no update again, I try to make use of the website but e still no dey load, so this kind of mean say the ban don take effect.
But as a sharp guy, ban no be for people like me, I don hurriedly go download orbit from Google playstore, and now everything is cool as ice, both the Twitter app and website dey work well now ones I connect VPN from orbit, I advice any body wey get any issue accessing Twitter to download orbit from Google playstore or iPhone app store, the app na totally free of charge, and no kind of in-app subscription or purchase either, no ads too, very clean and easy to use app.
Ehen, about TB Joshua sef. Una see sey death nor get respect for anybody na. Death nor send anybody oh. Once the time reach, e dey show sharp sharp.
The news shock me oooh, I no believe am when my wife tell me on Sunday morning when we dey prepare to go church, she say she see the news for Facebook, wetin I quickly think be say na fake news, na when I come enter Twitter na Im I come see say the matter na true oooh.
But my question na be say, why him people no won disclose the cause of him death or how he take die? Abi e get wetin they no want make the general public know?
Because e surprise me say a powerful man of God like TB Joshua go just die like this.