Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 04/03/2022, 06:04:39 UTC
Na true but any news for Nigeria that dey use Pigin? To show how English is significant to Nigerians as their only official language.

E plenty na, abi you never see true true? Most stations now get pidgin programmes so them no go lose out on followers. Even to the point sey a radio station open just to only speak pidgin o. You never hear of WAZOBIA FM weh get branches for Lagos, PHC and Abuja? Pidgin na big thing for the world to the point even BBC open belt for am.

Secondly as we no dey tool speak English here I noticed when outsider come dem dey give acknowledgment for invading the thread but if na English we dey speak dem go just contribute without any acknowledgement.

Na uniqueness dey make people pay attention to you, make we realized that and do wetin go benefit us.

Baba, I remove shirt, cap and trousers for you. I reason you well enter brain.