I agree with you bro, Nigeria Politicians dey thief money dey hide for house,inside coffin, inside well,sucker well and even bury money. Imagine wetin dem dey do our economy. Money wey people suppose to dey use for business so dat e go born children,na e dem imprison cum make people dey suffer. This recent flood wey happen one commissioner die for Bayelsa due to Cardiac attack becos say e hide money inside room before e go carry him family go Abuja for safety from the flood,for Abuja na e him hear say flood don reach e house before e go come back to Bayelsa flood don dey window level of e house,all the money don cast. Na wetin lead to him death. So the redesign go help small
Yes na di true be that, na dem bi di arm robbers with briefcase and suit. Nigeria get money die. If di politicians dey spend di money wey dem dey steal for we kwantri sef, money gede flow reach all corners but dem dey hide am till spoiled. Di flood really spoiled things in Bayelsa but I no hear dat story. Though dis days I no dey watch news again like that. In my own discovery of the flood matter, those who were really affected were not given any palliative but those who were not affected much were receiving donations from internal and external donors. Di amount Goodluck received from internal and external bodies were much more than even even the state allocation.
Na the poor masses dey always suffer,and na dem go dey suffer as long the country still dey under bad leadership.Election go soon come again,and the people wey dey aspire for political positions don dey plan on how to run the election using the poor people wey ready to do any kind of wicked act just because of money,and at the end of the day,nothing wey dem been promise them go come to pass.The moment then elect them put for those offices,them don start to dey thief money dey keep so that before their tenure go end,dem don get excess money for the rest of their lives.
the truth of the matter say both poor and average person they suffer for this country, and talking about leadership before that issue go solve now he go take time sha, because you see tinubu and atiku na wrong candidate them be and they ready to go any extent just to win the election, the sad truth be say does men no get any good intention for their citizens the thing done tire me self I swear peter obi na good man doh no body clean but is preferable than them tinubu and co but he no go easy for my guy to win oh because the go wan reg the election.