Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
martyns
on 03/12/2022, 10:22:30 UTC
⭐ Merited by igehhh (2)
Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible


As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.
Congratulations on your graduation boss. As you take finish your school, I pray better job locate sooner than you expect. Na favor market no be labor market you go enter. Amen to your prayers bro. Me sef wan graduate after seeing shege from Corona and ASUU strike, spent six and half years and still counting for a four year course... Omo!
We dey always talk say school na scam,we know say if you no hustle your way out,the school go be scam,but make we no still forget too say e get some people wey dey chop well because say them go school,and we know how our society be today,say if you no go the school,e go dey like say na your own worst pass,that is why bad as e bad,make we still go the school so that if opportunity come,we fit catch up with the chance.
Congratulation boss,e no easy,finishing the process.E means say you don try for your self,and make your family self proud.