Thank you my brother for the update. Dem don too decieve us say our votes no go count and yet dem dey buy PVC. If vote no go count why dem dey buy PVC? Why dem dey share money for polling unit to carry influence our conscience.
Make everybody stand up for the truth.
Stand up against people wey think say na dem get this country.
Stand up against "my turn" people wey don already share the country positions without our consent.
Stand up for those who don dey thief and wan be president since 1993 till date and yet dem go talk say na youths be the leaders of tomorrow.
PVC na e sure pass but still manipulation dey coded, now some people day y get like 5 PVC for hand on that day of election wey be their own and dem go use all the five cards vote just because of to collect money five times,underage na another way to do am. Imagine say one same person dey do PVC every time wey national elections won come up
Anybody wey neva go collect him own wet e do make e quick go now o,because e get as e go tey before u know this INEC people go sell am out to party leaders for the ward so that e go be advantage for them to use am on election day vote without you the owner knowledge. Let's kick out bad government for naija and no be by talk but na by action.
This na correct update sha atleast people wey never get their hands on their own go don know through this means or me self fit tell people for my locality about the pvc update. Omo election don close well well o and many Nigerians dis time around can boast for themselves that they are actually going out to vote their propose president in their minds inrespectful of the money that they will be given that day and even the government sef deh try to see if all this small coded wey you dey talk comot totally by maybe even turning the whole funds withdrawal system to a cashless one. On that day many tinx go sup wella but we Nigerians, make we make sure say we try vote who dey our mind even if den give u bribe, no be when we collect dat small change den come suffer again for 4years before we get chance to make impact to the change of government.