If I go understand you correctly as you mentioned brainboss, na him be the only merits source we get for we local board and from our understanding e be like say na only locals him fit dey give merits than any other sections for the forum since him merits na for localboard.
Abeg no reason anybody else here because na only brainboss be the merits source we get here na wetin make our people dey apply so that them go help we people grow as well.
I think you've got it wrong there @SmartGold01.our Nija local board never get any merits source.
@CryptopreneurBrainboss no be merit source but him dey among the generous oga them for we local board wey just decide to help other members with merits at free will. See am as he talk
Before I begin congratulate everybody I want to clear the board that the board don't have a merit source. I wasn't assigned as the merit source for this board so before you think I'm obligated to the board use ur head again. We need to go to meta and support every merit source application as in all e benefits the boards as those appointed to oversee the board will be obligated to distribute merits in discussion, I 'mostly' focused only on topics as that's what starts a quality conversation.
Na e make other of our other oga them like Charles-Tim, Igebotz de try apply for merit source so we go get our own merit source for here and so merit no go too dey scares for our Nija board. If you observe some other local board, them members dey always get merit Wella because Dem get merit source. The other way too be say we fit help our self, no be only meirt source go fit help. If you come across any post wey make sense Wella and u know say e deserve merit just drop if at all, this one go help that person motivate am to do more better for we local board.
~
As of this issue of pidgin or English, Dem don first settle am for before @Onyeeze. our people dem dey fit speak both English join pidgin sometimes sef we fit mix the two. As long as you dey understand watin the person the relate that wan no fit be issue na. Sometime e fit get thread wey person go wan make and to am pidgin no go sharp so e go decide to leave am for English. And if some people wan reply them go also love to use English. So e go depend on their choice.