Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 2 users
Re: Make we help our self
by
Nwada001
on 03/09/2023, 07:23:57 UTC
⭐ Merited by Lida93 (3) ,CryptopreneurBrainboss (2)
Please, come with informative, educative and useful posts next time.
If i dey your level i no fit come dey talk all this balah balah talk for my board, you b Sr man wey suppose the make the local board of naija to dey shine and our people wey dey new to dey grow but you dey attack your own people even 4 the local board you still dey attack Dem, na like this wey person go use make you leader wey you dey fine, e get any Tori wey our local board wey no dey educating, no do like sey you too sabi, I don tell you b4, you don too dey old to dey talk all diz kind of things wey you dey talk. Charles you no try as person wey sey e wan b leader

Some kind talk they tire me sha, I just dy wake up diz Sunday morning I say make I start my day 4rm our local board nah diz kind thing I come here come meet.

@Onyeeze, I don go through Watin Charles-Tim talk how many times me never see any direct insult inside, the only thing way him point out be say you suppose dy active first for the local board b4 u go complain say the local board no the help person, if you go through the local board well you go see say even newbies them they earn merit for here, some of them self nah here them they start earn their first merit den dem go use am start up life.

All of us get right to talk anything way we observe providing say we fit make our point valid and solid in the eyes of others, so if you no like Watin him talk for him last reply nah just for you to either give a statement way go justify ur own opinion or u leave am go ur way, sometimes eh get ways way u go do something even when u wan defend ur self u go don mess up everything blame go wan come they for ur side. Diz forum even if no be for this local board u no go expect everybody to concor to everything way u talk, U no be king Odomodo for movie way anybody way disagree with am him own don go. So bro to insult person way figure something out no even be the right way, the manner way u carry attack with insult no gel at all. Nah why dem they always advice us say make we they grow thick skin, bcuz even outside diz local board u go see worst of a disagreement response Watin u go come do for that side?

Make we they calm our self down sometimes eh they help…