If dem delist trading in Naira on every centralized exchange wey dey available to us, then we go either begin trade in decentralized exchanges or we go begin use local vendors, the thing be say using local vendors dey very risky and vendor wey you trust today, fit carry your money run tomorrow. As e be now, we still get a few centralized exchanges wey we go fit use, and make we hope say things won't get worse than it already is.
Local vendors sharp pass dex if you ask me, na just to get a trusted person and you dun dey trade with peace of mind. I still dey wonder why decentralized exchanges wey get Naira options never begin dey trend self. This things dey easy to do na just say person no get the coding experience to execute am. I think say we get entrepreneurs for the country, if na fiats now we for dun dey see dem begin dey launch different app but no one wan launch crypto own. Only God knows the kind money wey anybody wey launch a well designed sites for decentralized Naira P2P trading go make for this country.
And apart from those decentralized exchanges and local vendors, there are still other many alternatives in which I dey pretty sure boys go fit dey execute BTC to fiat transactions, and by that I mean either trading/selling BTC for US dollars or British pounds, and then converting our US dollars or British pounds to Naira, sharp..
Trust Nigerians na, we go discover a new means of trading Naira/USDT soon if the government like make dem block all current means of doing that. Person wey dey away self fit use am as him own hustle to dey do P2P wey be say we go just dey send dem USDT or USD and dem go convert am there and send us Naira back. Anyhow wey the governments like make dem do but boys go always find way to use dey alright last last.