Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??
by
Juicyhome
on 06/07/2024, 12:21:32 UTC

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job.

This point wey you make really grab my attention, to be honest Bitcointalk no be for the weak. And despite the criticism and backlash wey be normal thing wey most newbies experience, to grow for this forum person go need patience with zeal and willingness to learn. Also person go need dey tolerative and overlook the criticism. Our people say who give up na em fuck up, so I believe say those wey give up no get patience and dem no dey willing to learn that's why them dey give up easily over small criticism and backlash by senior forum members. For the forum endurance matters a lot, if you notice na those wey get endurance, wey overlook the criticism and improve with the things they learn from this forum na them wey rank up and na them dey enjoy the benefits of the forum currently, that's why oyibo say, "patience is virtue".
No be lie, na who give up fuck up main main. as newbie no too put mind on the cash, or benefit na to give yourself target everyday to make atleast 5 quality post everyday, before you know you don dey grow small small. na consistency and determination you need to grow rank here. no envy those ahead of you them pass same road u dey now. them too suffer before them reach senior, hero and legend rank. just do the one way u fit do for the forum and the forum will reward your hard work. no expect to open account today and u will just grow to full member e nor they easy like that, head up and work for your salvation. with time all you pray for will come to reality.

abeg make our oga at the top try help us with merit, na weytin fit they motivate us too, reward system they really help newbies to be active. no lose hope. keep build and the sky will be your limit.