~
We pray make the matter no reach that level because already Riverine Tribes/ communities don send warning threath to Wike and Martin's led assembly say " Any attempt to impeached Gov Fubara from Office say na declaration of war'
Make you nor let all dat empty threats give you hope oh. Wen e set you nor go see all those people wey make those threats. In fact, wen hand touch dem, dey go deny wetin dem talk like Bro P take deny Jesus. See wetin go happen if dem decide to impeach Sim, federal power go enta d matta wit dem security and arms. Everywhere go be like war wan start, those for riverine areas wey you dey talk go panic enta house. Dis awa kontry na deep hole, nothing like a democracy in practice. APC dey ruin am on daily basis wit impunity.