Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Trading no be get rich quick scheme
by
Lida93
on 19/03/2025, 11:28:32 UTC
Di rate way many people especially di younger ones de take rush enter crypto trading based on wetin dem de hear de very alarming. Unto say dem de find online jobs or side hustles, dem go get misleading information say crypto trading na di place to de make plenty money everyday. When dem rush enter and lose all dem funds, na dat time dem eyes go clear say no be get rich quick scheme and say trading no be for everybody.
I no know if Una do observe all these people way the come radio stations the talk about trading seminars and how people wey dey interested make them text a code to their phone number then them go reserve a seat for them. As in, this people go the talk for radio about how easy trading is, and how you don't have to fear or stress much to be a successful trader in no time.

Seriously, whenever I tune to these stations and hear this people talk I feel sad for the innocent people wey go believe their talks. But go later on realize am when them go done lose enough money wey dem no expect. Abeg make we dey try preach to people about the risks involved in trading more than we talk about the profits we make.
.
Then concerning those people wey you dy talk for radio station, see to be honest with you, some of them dy good in the business and they are making a living from it, where the major problem they is you that want to learn from them, the question is; you fit get to such level?
Because I believe say even for school wey lecturer dy teach, no be all students dy Sabi or even get close to the level of the lecturer, because in trading, you must show working, nothing like copy copy, so you must put in your own personal work and sacrifices just to perfect the craft,so that one nai make trading hard.
Before I go decide to send my details to get a seat available for me in such trading seminar it actually means say I really want learn and also Sabi and get that knowledge way those tutors for the seminar ground get. Nah why we no go fit just generalize am say the people wey go to learn nah no gree put ear for ground to learn am to the level those people way the teach them done sabi reach.
Trading I know say takes a lot of time and resources from the individual to be able to mature in it but many of these seminars no the carry them people along to the end as they ought to. Wetin I mean be say them no the dey patient with these students long enough to really sabi.