...but the way e dey go e come belike say people dey repeat wetin others don yan before.
You dey observe well. E don tey wey I don begin observe am sef and d thing dey vex me as I nor do am self–moderated wen I start am. Since dem wan begin spam here, I go begin strike dem posts out soon. Again, anybodi wey give yarn wey nor interprete well fit also get d strike going forward.
Normal level. We don tay for this thread, make person nor come rubbish am for us wey dey enjoy am. Person been dey suggest say make we pin the thread for the local board based on wetin the thread represent for us but as people dey spam am so e go hard. I never see you comment for the thread be like you never see am.
About the repeating of things other people don yan for this thread I go say e no easy to become elder overnight to dey chop words of knowledge and vomit am as proverbs. You know say the things wey people don yan before the new ones no go fit see their own proverbs as something wey the old members don talk drop so this thing go hard but if we do am like this say make we dey indicate say this particular talk person don talk am before e no go still easy. Me I go say make we still dey quote anybody wey don talk wetin another don talk for the person to also delete am other than to pin the thread, hmm, this thread na another thing wey dey give man joy here oh, Maegbu understand wetin I talk about this thread.