Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What you guys think about pi listing
by
Mpamaegbu
on 19/04/2025, 13:31:41 UTC
~
The only mistake wey some Pi community members do na to hype the coin say eh go high pass Bitcoin for future, come launch at  $314,159 wey dem claim say na GCV price (Global Consensus Value).
Na so TBC fans too talk dat year, around 2017/2018. I hope you go still remember TBC – The Billion Coin. D community hyped dat project wetin nor good sey e go betta pass Bitcoin and sey e go bench Bitcoin wen listed. E com be like see finish for Bitcoin. Dem com begin quote how persin go take am buy landed properties and all dat. As people wey go school dey put am – Time shall tell. Till date, we nor see TBC reach as we dey so.

E go betta make dem completely stop d mining now sef bc wetin dem dey give persin daily this day as dem don list nor dey encouraging at all. I seldomly dey mine again. Six months dey too far but dem go stop sef. Make dem do am now.