Make I no lie, I no want make the naira gain against the dollar. Infact, make e dey even depreciate dey go. I no need to pretend because the way the economy bad and our leaders no dey do anything, even when them fit, e no go come reach my turn before I go start to dey look loyal.
Countless opportunities bin dey for the naira to be at par with the dollar but e come look like say we leaders dey content to adding value to another man currency than their own. This matter no suppose shock me because when you dey earn in dollars, you are regarded as person wey get money and even when you decide to spend, nah naira you go convert am to oh, but still, better change go dey.
As e be, I no sure say the naira dey in any battle with the dollar. Better still, the dollar don win since and the naira just dey live in the shadows of wetin e used to be. Make I shock you, before, the naira bin get more value than the Ghana cedi but e no look like that anymore. Countries wey bin dey rely on the naira don wise up, put more effort in not just their economy but their currency but I wonder why Nigeria no wan wake up.
I just like how sincere you are about this dollar-Naira thing and to be sincere I know say no be only us de feel that way about am. It's not as if I no want make the country better or anything but the way things de go no de encouraging at all na why if Naira appreciate against Dollar I no de happy like. Naira go appreciate but cost of living still de go up na where the matter tire me be dat.
It's not supposed to be so, but the leaders and even market people no go wan drop price of things, everybody just wan extort others na why things no de get better. Sometimes we can't blame the government and leaders alone because we the people are not helping matters. Food wey we de grow ourselves no wan come down even as Naira value de appreciate.