Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Invest in bitcoin or save your money in the bank.
by
Umulala-alala
on 05/08/2025, 09:20:16 UTC
If you check, na why e talk say, e depend on the plans you get for that savings and how long you wan save am, this is why e Dey good to get emergency funds, so that you no go need to go run meet your investments or savings anytime wey you get emergency or money wahala. But if you no get long term plans for that money, then the bank na e be the best option to save, so that anytime you just need am, you go just go there go collect am without stress, and you no go Dey bother whether btc dey go up or down.

Better truth dey this matter as no be every cash wey person supposed to invest. We no suppose dey put all our eggs for one basket but separate them to avoid any complications. As you get dey invest for Bitcoin, make you dey get savings too.

Na that savings go give your investment money enough space to do well because the more you get funds to handle any business wey come up, the better for the investment as e go ust dey grow with time.

Wahala money dey very important pass anything because that investment wey you dey run so, you no even sure if na sure plug and irrespective, anything fit still happen wey go make you lose all your investments then and if you no been get backups na there problem go begin to start from as you'll now have to start from the ground to build yourself up without any financial backing.
I so much like this your talk way you say we no supposed put all our egg for one basket and no true talk be that, one of the reasons to to put our egg in different basket is incase one side no work the other side fit still dey sustain man to diversify in different businesses or Investment na e sure pass instead of putting all hope in just one thing as anything fit sup I don learn some thing for this talk.