My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam

I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals

I don lose some dollars now.
Chaiii! E just be like say you dey my mind. The trading eh, e be like say na you(we) them dey wait for. Like say one man just dey wan side dey move the wave and as e dey move am, e dey watch you. Once you say make you place trade, na once you go begin see consolidation or the trend go just go against you.
E con be like say, the theory way person know don dey out dated. The matter tire me just now.
I been venture into trading in the last couple of months back, baba na the same thing I see ooo. Once you place your sell other and it bought up boom the market go just speed up but when you come buy na then the market go just drop. I lost almost all my profits and even capital join self but I borrow my self brain I come jarpa.
I talked wit one of my bros nd him said dat de market be like sey na watch something, once u never buy hmmmm de market go dey show plenty green colors 'BUT' wen u buy na dem ur village watch go come turn dat green wey u see just now to 'RED'. I bought KAVA some months ago nd dis coin no wan reach $3 make i sell for profit, u see how dis life no balance abi?. Broda make we no worry too much becus our turn go soon reach.
<snip>... In the meantime, I hope una been take advantage of the recent green market in crypto? Don't forget to take profits wey you fit use for Christmas sha.
Yes oooo, but some people still enter dat mottor wey carry some investor back in 2017, wit my koro-koro eye ethereum fell nd as i sey make i take profit wit my little stash my trade was cancelled nd i went down in sorrow, broda u see dis life eh, God dey.
I wish u success in your EXAMS, make sure sey u get 'A's abeg, becus AAU Ekpoma no go ever give u dat tin wen u dey Computer Science Dept, maybe dem don change shiaaa.