Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: This idea go reduce our daily expenses.
by
rachael9385
on 06/11/2023, 15:20:14 UTC


My brother this bike fine and e dey economical also and if you check the price too e dey fair. I no know which country you wan order from and the importation fees. My major  challenge for this bike be say e fit make you dey stranded because the battery wey you charge fit finish unexpectedly for middle of road. Just like if petrol finish you go enter filling station. But for charging, e fit hard because normally light sef no dey Nigeria like that.
If you look am you go under say the country dey connected for suffering. Light sef no dey, petrol come expensive and people are looking upto gass now.
I know everyone has there own points but come to think of it okada man tire dey less for road and en dey push am go volcanizer abi? And fuel dey finish for some motor the owner dey push am go filling station Shay? So even if the electric bike battery off for road we go still push am go our house nah naija we dey, the only way to overcome this situations nah to dey very observant to the battery percentage and make we calculate the distance before we move go any destination, So my brother that one no be issues.

Make i chip in, for this matter so, shey na as you de drive, the battery go de charge, abi no be so e suppose be nw?

By the way to import am be the wahala, cos of custom duty clearance and Also with this kind of epileptic power supply we get, this one go be issue ooo, and no forget say na prepaid meter we de use for some areas like that..

Anyway make we just help ourselves de manage the country like dat
You just dey talk like person way know even know watin em dey talk about.
Make I calm down ask you one question because I believe say you go don enter moto before, NAH WHEN MOTO DEY ON MOTION NAI THE FUEL DEY REDUCE ABI NA WHEN THEM PUT AM FUEL?. if you know the correct answer then you go fit answer your self the question way you ask.




My brother this bike fine and e dey economical also and if you check the price too e dey fair. I no know which country you wan order from and the importation fees. My major  challenge for this bike be say e fit make you dey stranded because the battery wey you charge fit finish unexpectedly for middle of road. Just like if petrol finish you go enter filling station. But for charging, e fit hard because normally light sef no dey Nigeria like that.
If you look am you go under say the country dey connected for suffering. Light sef no dey, petrol come expensive and people are looking upto gass now.


Ehhnen na waiting I be wan talk you just talk so,although the bike good and he dey very well wey be say you fit buy but if you take look at this our country now light is one of our problems and the light matter sef lead to the process wey be say another country wan give us light, if we buy that bike now how we go take charge am abi person fit use generator charge am too, as the bike dey so if person wan charge am again you fit use more than 24 hours charge before E fit get better charge wey go hold am tight wey go make am move very well, because as I dey even see the bike like this E fit mess up if person dey go somewhere or the thing fit go stop for road, but thank God say the thing no even heavy like that Grin.

And again I don't think the bike fit go places wey too far like that, like when person is going to travel to somewhere, the only place wey I think say person fit go with am be say make person just dey waka with am up and down for town if not if anybody try to carry this thing go long journey I swear that person Don suffer because the person go know the different between fuel and charge Grin, no be say I dey try spoil the matter oo, but we should also know that everything get advantage and disadvantage.
If driver dey drive moto shey em dey gage the fuel miter? However for the video (if you done watch am) you go hear when the guy speak out the numbers of kilometers way this bike fit run if the bike dey full charged, so with that you go fit calculate your self well use the bike the way be say you no go dey stranded for road side. Well..