Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: What you guys think about pi listing
by
Son Of Blockchain (SOB)
on 19/04/2025, 14:11:30 UTC
~
The only mistake wey some Pi community members do na to hype the coin say eh go high pass Bitcoin for future, come launch at  $314,159 wey dem claim say na GCV price (Global Consensus Value).
Na so TBC fans too talk dat year, around 2017/2018. I hope you go still remember TBC – The Billion Coin. D community hyped dat project wetin nor good sey e go betta pass Bitcoin and sey e go bench Bitcoin wen listed. E com be like see finish for Bitcoin. Dem com begin quote how persin go take am buy landed properties and all dat. As people wey go school dey put am – Time shall tell. Till date, we nor see TBC reach as we dey so.

E go betta make dem completely stop d mining now sef bc wetin dem dey give persin daily this day as dem don list nor dey encouraging at all. I seldomly dey mine again. Six months dey too far but dem go stop sef. Make dem do am now.

Bitcoin done suffer for most of these Shitcoin their hand anyone wey come go dey give community hope abi their community go dey hype am say eh go beta pass bitcoin cause of their personal interest, so be small see finish and I thank God say Pi do all those GCV people, " taa shut up" after eh launch.
 Even Pi creators self dey respect Bitcoin wey be the head of all Cryptocurrencies I no know why those hype men wey call themselves Pi GCV pioneers go dey talk nonsense dey deceive people for media say eh go high pass Bitcoin for future, in the next decade eh no go even smell Bitcoin back.