Have looked at it in my own way. That Nigerian’s can actually hold corruption politicians accountable by not taking bribe.
How I wish we can really do without taking bribe from any politicians, then that’s really going to be a nice one, but the politicians have imposed suffering on us that, they know when they come to us with just small amount, we won’t have choice than to just collect due to suffering. Some people go even talk say if I no collect the bribe, another person go still collect am, and dem go still win, so make I just collect my thing, and some so talk say maybe na the only benefit wey I go fit get from them in the next four years so make I just collect my thing.
Almost everybody don dey corrupt for this country now, no be only politicians they corrupt now, everybody just dey look for opportunity to cash out, even we wey be youth, any small post wey we hold, we go wan miss use am. But how I wish say we go fit dey smart if campaign period come, any politician wey come campaign with money, make we reject am, na the work wey you don do you go use campaign, and anyone wey no get any better thing to show, then make we vote am out.
It’s just high time we stop voting for parties during elections, it’s better we vote for people on what they have done, irrespective of the party the person is, and if you do 4 years and you performed below people’s expectations, then make dem vote you out, na that time most of our politicians go get sense.