My brother!!!!!
Username: Kryptokings
Gender: Male
Country and state of Resident: Nigeria/Port Harcourt
LGA: ONELGA
I m really happy to be among the forum and i have gained lot of experience here, as the case may be i m good in creating google form, spreadsheet and any kind of response form. I track members who are cheating in the forum mostly at the bounty sections.
i know i have met a brother here and i will be Glad to work with you as i have known you for long. only thing be say you no gree carry me along, show your brother man love make we survive together "Abeg cut soap so for me na" like this i dey roast for this place. But no see am say na worry i dey worry you oo.
Omo, na so we get men them for here! No be chaise o. Where you chuck head since na, way be say, person no dey even observe say man like you na omo naija. Paddy, you dey very welcome to this our small corner way we dey manage. No worry, now cef eh, we no dey fine the soap again. Even the foam cef way from the strong hands men them, the one way be say, as them baff, e gum for bathroom wall, only that one cef eh, e go wash you clean. You know this matters na,,, eh hehe, na so e just be. The only thing be say, you go try make your face no scares for here. You na strong hands so, you fit still drop me small foam o. Eheh, we dey together no be chaise. You dey very welcomed.
No worry bro any how e be we go survive for the industry but make we just try keep our hands clean unto say our name for the industry no go well at all so we go avoid anything wey go stain us or put spot for our body say make them no come label us say na them, everywhere dem dey behave desame. ony do legit hustle o, no carry street walker enter here oo so dat dem no go vex flush us from dis place we dey try to carry survive. like this now here done rilly make me happi for life oo.
so na beg i dey every bodi way from 9ja say make we maintain the good work here forget everi everi.
if you get work carry your brother along so dat him too go chop any how any how everi bodi get family so our mama them too go also chop for house.
i come in peace and na only me walker come